Close Menu
wahalaupdate
    Facebook X (Twitter) Instagram
    Trending
    • Colgate’s Big Brother Naija Task Sparks Entertainment and Debate
    • Ukrainian Refugee Stabbing Exposes U.S. Safety Failures
    • Apple Unveils Thinnest iPhone 17, AI AirPods: Innovation or Hype
    • England Dominates Serbia World Cup 5-0: Shining Stars
    • UK Home Secretary Suspend Visa Over Migrant Wahala
    • Real Warri Pikin Gender Reveal Party Don Cause Big Wahala
    • Court Comot Ali Baba From Him Multi-Million Naira House
    • Péchier: French anaesthetist faces trial over alleged poisoning of 30 patients
    Facebook X (Twitter) Instagram
    wahalaupdatewahalaupdate
    Demo
    • Home
    • Latest News
    • Trending News
    • Hot Gist
    • Celebrity Gossip
    • Pigin Coner
    • African Tales
    • More
      • Contact us
      • About us
      • Write with us
      • Whistle Blower
      • Advert Placement
    wahalaupdate
    Home » Akwa Ibom government don tok say na fake prophets manipute gov Eno pikin
    Pigin Coner

    Akwa Ibom government don tok say na fake prophets manipute gov Eno pikin

    wahalaupdateBy wahalaupdateJune 3, 2025No Comments0 Views
    Facebook Twitter Pinterest LinkedIn WhatsApp Reddit Tumblr Email
    Akwa Ibom government don tok say na fake prophets manipute gov Eno pikin
    Share
    Facebook Twitter LinkedIn Pinterest Email
    Spread the love

    Akwa Ibom State Government don com out June 2, 2025, com tok say na “fake prophets” manipulate Mrs. Jane Eddidiong Ufot, wey be Senior Special Adviser to Gov Umo Eno, to do dat viral video wey she accuse her papa say e get hand for her mama death.

    According to di report Vanguard news, wey dem tok dis one for statement wey Commissioner for Information, Aniekan Umanah, com release for June 2, 2025

    According to di government, dat video na just emotional outburst from pikin wey dey mourn her mama, and say na pipo wey dey mislead her push am to believe say politics get hand for her mama death.

    Umanah tok say di video no be direct accusation against Gov Eno, na just pain and confusion from pikin wey dey try handle big loss.

    Umanah com still dey yarn say, “di pikin just dey find attention and comfort from her papa as e dey pain her well well.

    Di video na just emotional outpouring, no be say she dey accuse di governor directly.

    Heim com vex for pipo wey dey share di video for social media, say dem wan use di family wahala take do politics and spoil di governor name.

    Umanah tok say di way wey dem dey share di video na part of di bigger plan to distract pipo from di good work wey Gov Eno dey do for Akwa Ibom with him ARISE Agenda.

    Dis wahala start afta Jane com just post video wey she dey cry, dey beg her papa to do something before “dis thing destroys,

    ” She tok say, “I no be sacrifice. As my Mummy be, me no be. I give you few minutes, if you no act, I go post am everywhere.

    Di video go viral quick, pipo begin tok different things.

    Gov Umo Eno sef com address di mata for di public event for Uyo, with him family, including Jane, dey by him side.

    Him com confirm say di video na old one wey dem record just afta him wife die for September 2024.

    Him com tok say na pipo wey no like beta dey bring am out again now wey dem dey celebrate two years for office and dey mark achievements.

    Di governor tok say, “We dey for political season, so all dis kind things go happen.

    My family dey kampe, una fit see everybody here.

    “Di video na old one, so why e dey com out now?

    Na clear sign say detractors dey.”

    Him beg pipo make dem respect him family privacy and make dem allow him late wife rest for peace

    Him still promise say all this political drama no go make am lose focus for di work wey him dey do for Akwa Ibom pipo.

    Government still clear di air say di First Lady die peacefully aftar small sickness, and all dis tok tok say she be “sacrifice” na just pain and manipulation from outsiders.

    Dem tok say Jane na pikin wey dey mourn, so na emotion make her tok those things, no be true.

    Afta di First Lady die, Gov Eno put him first daughter, Lady Helen Obareki, to continue her mama project for di state, show say di family still dey united and dey serve di pipo.

    Akwa Ibom government com beg public and media make dem handle di mata with sense and no allow politicians use am scatter di state.

    Dem say make everybody focus on unity and progress, no be division.

    Umanah still yarn say all dis pipo wey dey use di video take run campaign against di governor just dey fear di progress wey Gov Eno don bring.

    Him tok say, “At no point for inside di video Jane accuse di governor of her mama death.

    All dis pipo just dey look for how to spoil pesin wey dey work.”

    Di government say dem no go let dis kind mata distract dem from di beta work wey dem dey do for Akwa Ibom.

    Dem still dey beg everybody make dem no dey share or believe everything wey dem see online, especially when e concern family pain.

    As di state dey move forward under Gov Eno leadership, officials say dem go continue to dey focus on development, unity, and beta life for Akwa Ibom pipo.

    Dem urge everybody make dem join hand to move di state forward and no allow politics divide di pipo

    Wahalaupdate go still dey follow the mata and bring una more tori as e dey happen.

    If anything new show, we go let una know.

     


    Spread the love
    Akwa Ibom State Govment Governor Eno
    Share. Facebook Twitter Pinterest LinkedIn Tumblr Telegram Email
    wahalaupdate
    • Website

    Related Posts

    UK Home Secretary Suspend Visa Over Migrant Wahala

    September 9, 2025

    Real Warri Pikin Gender Reveal Party Don Cause Big Wahala

    September 9, 2025

    Court Comot Ali Baba From Him Multi-Million Naira House

    September 9, 2025
    Leave A Reply Cancel Reply

    Hottest Gist

    Colgate’s Big Brother Naija Task Sparks Entertainment and Debate

    September 10, 2025

    May Yul-Edochie Accused of Secret Cosmetic Surgery Loans

    September 8, 2025

    Temi & Mr Eazi’s Lavish Multi-Country Wedding

    September 7, 2025

    TikTok star Peller rise from nothing reveals generosity secret

    September 5, 2025

    TikToker Peller calls Davido stream failure; Wizkid transformative

    September 5, 2025

    Subscribe to Updates

    Get the latest creative news from FooBar about art, design and business.

    Colgate’s Big Brother Naija Task Sparks Entertainment and Debate

    September 10, 2025

    Ukrainian Refugee Stabbing Exposes U.S. Safety Failures

    September 10, 2025

    Apple Unveils Thinnest iPhone 17, AI AirPods: Innovation or Hype

    September 10, 2025

    England Dominates Serbia World Cup 5-0: Shining Stars

    September 10, 2025
    © 2025 ThemeSphere. Designed by ThemeSphere.

    Type above and press Enter to search. Press Esc to cancel.