
Na so Jamiu Abiola, di Senior Special Adviser to President Bola Tinubu on Linguistics and Foreign Affairs, yarn for June 12, 2025.
During Channels Television June 12 Special Forum wey dem hold to celebrate Naija 26 years of democracy wey no break.
Jamiu na pikin to di legendary Moshood Kashimawo Olawale (MKO) Abiola.
Di man wey suppose be Naija president for 1993 but dem no gree.
Jamiu talk say if MKO Abiola for be allowed to rule, Naija for don dey enjoy beta economy today.
E talk say 1993 na special time for di whole world because economic boom dey everywhere.
But Naija waka enter wrong road because one kleptomaniac waka come be head of state.
You sabi who I dey talk about na?
Di man wey everybody know as thief-in-chief, no be small thing.
E talk say, “Na 1993, di world dey enjoy big economic boom.
But wetin naija get na Kleptomaniac as head of state.
I no go even mention Sani Abacha because everywhere e go, wahala dey follow am like shadow.”
MKO Abiola: The President who never get a chance to rule
Jamiu no gree make pipo forget him papa.
E talk say afta 32 years wey election cancel and 25 years afta MKO die.
Some pipo still dey try erase di name of MKO Abiola from naija history book.
E complain say foreign leaders dey come naija, dem go mention Yar’Adua.
Dem go mention others, but MKO Abiola name no dey.
E talk say, “Dem wan bury my papa name.
Like my papa go talk, dem wan shave him head for where e no dey.
Na why I write book for 2015, ‘The President Who Never Ruled’, so dat pipo no go forget am.”
Di Tori Wey Dem No Wan Tell
Jamiu also yarn about General Ibrahim Babangida (IBB) and di wahala wey surround di 1993 election.
IBB admit say MKO Abiola win di election, but General Sani Abacha cancel am.
Jamiu call di cancellation “tales by moonlight,” meaning say na lie wey dem tell to cover true.
E talk say, “Nothing stop IBB say make him tell Abdulsalami, di next head of state, say;
‘I no gree cancel election but Abacha want kill MKO Abiola.
Abiola dey jail, why you no free am make e go do medical checkup before e die for jail?”
According to Jamiu, even if IBB no talk make dem reverse di cancellation, e for at least allow MKO Abiola go hospital.
But because Abacha die, dem fit announce di real result when Abdulsalami take over.
Maybe MKO for still dey alive today if dem do am beta.
Di Wahala of Naija Politics
Na so Jamiu Abiola talk am, but make we no forget say na wahala full ground.
Imagine say one kleptomaniac fit block naija from tapping into international economic boom just because e like to Dey thief grab money.
Naija for don dey shine for world stage, but no, we dey suffer because of greed and bad leadership.
E be like say for naija, if you no thief, you no fit rule.
Di man wey suppose be president na honest man, but dem cancel am.
Di thief waka enter, grab power, and naija waka enta wahala.
Na so e be for our country.
Make We No Forget MKO Abiola
Jamiu Abiola remind naija pipo say make dem no forget MKO Abiola.
Di man no get chance to rule, but e fit change naija tori if dem gree.
Now, 32 years don pass, but di fight to remember MKO still dey go on.
So, as we dey celebrate 26 years of democracy, make we remember say democracy no be only to vote, but to choose di right pesin wey go make naija beta.
No be thief wey go steal our future. Na so di mata come be.
Leave a Reply