Labour Union pipo dem order workers say make dem go strike

Labour Union pipo dem order workers say make dem go strike
Spread the love

Wetin  com dey shock everybody for Naija now be say labour unions don tell all di federal workers say make dem sidon for house, no go work, from midnight Sunday, June 1, 2025.

Dis kind strong mata fit scatter government work for di whole country, and e dey happen bicos of all di meeting wey union get with federal government about salary and allowance wahala  wey no yield anything.

Strike Order: na di last option abi or na political game

Di circular wey National Working Committee (NWC) and National Executive Council (NEC) of di union sign no get any confusion inside.

Dem talk say all federal chapters must to sidon for house “until further notice.”

Dem vex say all di meeting with Minister of Labour and Employment no bring dem beta result.

Di wahala get three main things wey union dey ask for:

  • Make government pay five months wage award wey dem owe workers.
  • Make dem start to dey pay ₦70,000 as National Minimum wage
  • Make dem quickly add di 25/35 percent salary increase for federal workers

Union pipo talk say government don dey do promise and fail, delay things, so workers no get choice again than to shutdown everywhere.

But some pipo dey reason say, dis strike na really for workers benefit or dem dey use am do political fight between labour and government.

Governemnt Side: Dem no send or abi dem no sabi

Di way government no dey answer union demand don make pipo dey suspect say maybe dem no sabi do di work or dem just dey try weaken labour power.

Minister of Labour and Employment wey suppose settle di mata neva fit arrange any beta agreement, so millions of workers just dey stranded.

Some pipo even talk say government dey use delay tactics, dey hope say as pipo don begin to dem suffer, dem go blame union.

Others believe say government no get money to pay all di things wey dem promise as economy dey tight.

Wetin go happen now: public service wan collapse

As strike don start, di effect don dey show everywhere. Hospital, school, immigration office and other government work don dey shutdown.

Di wahala go heavy, as millions of Naija go suffer from late medical care, school wahala, and government office go slow down.

Social media don catch fire, pipo  dey vex, dey blame both government and union say dem dey use ordinary pipo play politics.

Some dey talk say, yes, workers suppose get beta pay, but to shutdown everything na wahala for the same pipo wey union dey fight for.

Di wahala: who go suffer pass

Di controversy wey follow dis strike deep well. Union dey demand wetin dem believe say na dia right: pay for work wey dem don do, beta salary, and increase bicos things don cost.

But government no dey do anything, and e dey make pipo dey wonder if dem really serious.

But na Naija wey no get hand for di fight go suffer pass, as dem go face hardship while leaders dey argue and dey stubborn.

Some pipo even talk say union and government dey use pipo life play politics, some say union dey use strike as weapon to collect wetin dem want before another political meeting.

wahalaUpdate talk: Make dem put Nigeria first

Wahalaupdate believe say time don reach for both government and union to put Naija pipo first.

Di way negotiation dey go, no transparency, no clear plan, dem just dey allow public service to collapse all dis na sign say di system don spoil.

If government no fit pay, make dem talk true give pipo.

If union mean well, make sure say di strike no go too affect di same pipo wey dem dey protect.

As strike just dey start, di mata serious.

Government go hear workers demand or dem go wait make pipo taya.

Union go still dey togeda or pressure go scatter dem.

One thing clear: Naija dey crossroads again, millions of lives dey hang.

Wahalaupdate go dey bring una beta gist and analysis as di strike dey go.

For now, everybody dey wait, dey hope say justice go come, but fear dey say wahala fit long.

Abeg, make you dey follow Wahalaupdate for di latest tori as e dey happen.


Spread the love

Be the first to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published.


*