
Na so di former Ekiti State Governor, Kayode Fayemi, come yarn for democracy day wey be June 12, 2025, during one special event wey Channels Television organize.
Di event na to celebrate Naija democracy journey. Di “Nigeria’s Democratic Journey” An Inter-Generational Conversation On Building A Better Nation.” Fayemi no gree say Naija dey practice full democracy June 12.
E talk say na only omomo-democracy we get Naija for now, and di real democracy still dey road.
1999 Na only di beginning, no be full Democracy.
Fayemi talk say, “Make we no confuse election with democracy.
For 1999, Naija only come back to civilian rule, and dat one na just di right to vote for leaders.
Dat one be omomo-democracy. By.”
E talk say, “We get civilian rule, we dey proud to dey on di journey, but no be full democracy we get.
Di work wey previous president and now President Bola Ahmed Tinubu dey do, everybody must to continue to dey build on top am.”
You sabi say for Naija , Pipo dey always celebrate democracy every year, but Fayemi dey remind us say democracy no be only to vote.
Say democracy na journey wey still get many steps to climb.
Di Wahala wey we Dey face for democracy struggle
Fayemi also remember how e and other democracy fighters suffer under late military dictator Sani Abacha.
E talk about Radio Kudirat, one radio station wey dem use take fight for democracy.
Many pipo die for dat fight, but some survive.
E yarn, “No be say we no fear, but we no really sabi how big di danger be.
I carry Radio Kudirat transmitter for Air France flight wey suppose go Cotonou, but e make detour to Lagos.
If dem catch me for dat flight, I for don die like many other pipo.”
E talk say for Oputa Panel Commission, some pipo wey dem send to kill democracy leaders come tell their stories.
Fayemi say, “Make we no take di mata joke oo.
We no be invincible, na luck make some of us still dey alive.
Those our pipo wey die no be fools, na because dem believe for di cause.”
Fayemi Praise Tinubu, But Still Talk Say More Recognition Needed
Fayemi hail President Tinubu say him give some democracy fighters national awards for di event.
But e talk say many pipo, especially those wey run Radio Kudirat, still need recognition for their sacrifice.
E talk say, “Dem deserve to be remembered well well because without their sacrifice, democracy for Naija no for reach dis level.”
Naija Democracy Na Half-Pipe
But make we talk true, Fayemi no dey carry last for dis mata.
Naija democracy na like half-pipe wey pipo dey try climb, but no reach di top.
We dey celebrate democracy like say we don reach promised land, but di road still long.
Imagine say for 26 years since 1999, we still dey talk say democracy no complete.
Na only to vote we get, but real di democracy wey go make life better for ordinary Naija pipo dem still dey far. Na so e be for Naija.
Democracy We Just Dey Pretend
You fit laugh say Naija democracy na like say pesin get bicycle but no get chain.
E fit move small, but e no fit go anywhere.
We dey vote, but many times, di real power dey with pipo wey no dey elected. Na so di mata be.
Fayemi talk say make we no confuse voting with democracy.
E mean say if you dey vote but di government no dey work for you, you no get democracy.
You just dey play democracy like football wey no get ball.
Make We No Sleep for Democracy mata
Fayemi talk say democracy na journey, and Nigeria still dey road.
E mean say we need to dey work harder to make democracy make e be real.
We need beta leaders wey go respect pipo, no be thief or dictator.
We need to remember those wey sacrifice their lives for dis struggle.
So, as we dey celebrate democracy anniversary, make we no forget say di work never finish.
We still get many wahala to solve before Naija fit claim say e get full democracy.
For more update follow us on wahalaupdate
Leave a Reply