
For inside Thursday, June 12, 2025, for one big event wey dem call June 12 National Dialogue, political economist, Pat Utomi come yan one serious mat wey go make your belle dey pain you.
Di event wey Eminent Patriots of Naija organize for Lagos carry big theme: “Democracy without a Democratic Constitution: Which Way for Nigeria?”
Na there Pat Utomi open him mouth talk say di dreams wey pipo fight for democracy no even near to come true till today.
You sabi say June 12, 1993, presidential election na one historic day for naija pipo dem.
Pipo die, pipo suffer, all because dem want make democracy shine for Naija.
But Pat Utomi come talk say afta more than 30 years, democracy still dey waka like pesin wey no sabi road.
E talk say naija never fulfill di promise wey democracy suppose bring.
Pat Utomi talk say, “When we fight for democracy, we dey expect say by now naija for dey among di top 10 countries for di world.
But see where we dey today. Na dis kind democracy some pipo die for?”
E talk am with plenty pain and sarcasm
E no gree say di struggle for democracy suppose end like dis.
E come talk say even though di country dey suffer, naija pipo no suppose give up.
“Naija pipo must to fight to take back their freedom.
If we die, we die. Naija go rise again,” e come dey talk like say e dey prepare for war talk.
Dis kain talk na serious wake-up call for everybody wey dey look democracy as just talk and empty promises.
Other Patriots Join Body
No be only Pat Utomi wey talk for di event.
Former Minister of Finance, Idika Kalu, and other patriots like Gboyega Adejumo, Wale Okunniyi, Chris Iyovwaye, Maxwell Gidado, Mike Omeri, Nwogwugwu Uche, and Wale Okunniyi also come join body to talk say democracy no suppose be joke.
Dem talk say make government dey accountable, make institutions dey strong, and make pipo dey serious about democratic reforms.
Di whole gist be say naija democracy dey like pesin wey dey waka with one leg.
Pipo talk plenty, but action no dey. Government dey do like say dem dey run country, but di pipo no dey feel am for their body.
Economy dey hard, insecurity dey everywhere, and corruption just dey chop like say na festival.
Make I yan you, Pat Utomi talk dis one with plenty sarcasm and pepper.
E dey shout say democracy no be only for mouth talk or big big ceremony.
Na serious mata wey suppose change di life of ordinary naija pipo.
But di truth be say, democracy for Naija dey waka slow like snail wey carry heavy load.
E talk say if democracy na wetin some pipo die for, then di kind democracy we get today na big disappointment.
E be like say di pipo wey dey run fi show no sabi wetin democracy mean.
Dem dey enjoy power and comfort, while di masses dey suffer for street.
Di Fight Must Continue
Pat Utomi no gree say naija pipo dem go just fold hand make things continue like dis.
E talk say d fight for freedom no suppose stop. Even if pesin die for am, e no go be waste.
Because naija go rise again, no mata how long e go take.
Dis kain talk na serious slap for government and politicians wey dey enjoy their own comfort while di pipo dey cry.
E remind everybody say democracy na for di pipo, and if di pipo no dey happy, then democracy no dey work.
Wetin naija Suppose Do
Di message clear: naija pipo suppose no gree make democracy remain empty talk.
Dem suppose demand real change, real reforms, and real accountability.
Dem suppose dey vigilant, dey push government to work for di pipo, and no gree make corruption and bad governance continue.
Di June 12 National Dialogue na good platform to remind everybody say democracy still get hope if pipo no give up.
Pat Utomi and other patriots dey call naija pipo say make dem wake up, stand up, and fight for the kind democracy wey go make life better for all.
So as of June 12, Pat Utomi don put everybody for alert.
E talk say democracy no be joke, but di way things dey go, e be like say Naija democracy na comedy show wey pipo dey laugh for but no dey take serious.
E talk say if democracy na wetin pipo die for, then di one we get now na big disappointment.
E talk say naija pipo must to continue fighting, no mata how tough e be. If we die, we die.
But make we no gree make democracy remain only for paper and for mouth oo.
Make we demand bâta, make we demand real freedom, make we demand real change.
Na so di mata be. Make we dey watch how dis fight go continue, because democracy no suppose be only for big men talk, but for beta life for all naija pipo.
If not, then wetin all those wey die for democracy go mean?
Na question we all suppose dey ask ourselves every day.
rc82in