Oshiomohole fight Air Peace staff

Spread the love

For Wednesday morning, June 11, 2025, one big wahala burst for Murtala Muhammed Airport, Lagos, as Senator Adams Oshiomhole waka come late for him Air Peace flight wey dey go Abuja.

Di flight suppose comot for 6:30 AM, but Oshiomhole show face for terminal about 6:10 AM, just 20 minutes before takeoff.

But na so so kasala start from there.

Air Peace no gree let Oshiomhole enter because boarding don close, as dem dey follow strict on-time departure policy.

Di flight take off sharp sharp as scheduled, no delay for anybody.

But Oshiomhole no gree hear word.

Instead, e start to dey shout, push staff, even block entrance gate so other passengers no fit enter di terminal.

E even climb conveyor belt like say na playground, and order him security men make them seal di gate.

Airport come turn drama ground

Air Peace come release statement talk say Oshiomhole behave like mad pesin, disturb flight operations, beat their staff, and cause big gbege for inside airport.

Dem talk say na serious bad conduct from one big politician and dem no go tolerate any kind violence for their staff or passengers.

But Oshiomhole no gree with that story

Him talk say na Air Peace dey do anyhow, dey sell ticket for high price afta dem don already book online for cheaper price.

E claim say e reach airport early, do online check-in, but dem no gree let am enter.

E accuse Air Peace of racketeering and mistreating passengers.

According to am, na so so wahala dey for airport that morning, and e be like say na riot.

E even complain to Minister of Aviation, Festus Keyamo, about di mata.

Peter Obi, di popular political figure, no gree siddon look as Oshiomhole and Air Peace dey fight.

As e come hear di gist, e come use him official X handle take yarn say Naija elites and politicians suppose support indigenous businesses like Air Peace.

According to Obi, running business for Naija no easy, especially for capital-intensive sectors like air transport.

E beg make pipo say make dem dey encourage local businesses, no harass dem, because na so economy go grow and jobs go dey plenty.

E come end with one optimistic line, say “A new Nigeria is possible”.

Meanwhile, Minister Festus Keyamo don order aviation agencies make dem investigate di whole mata well well.

E beg both parties make dem stop all public shouting and accusations, so dem fit hear all sides before dem make any judgment.

Di investigation dey ongoing as we Dey talk like dis.

  • So, na so di whole mata be: Oshiomhole late, Air Peace no gree wait, Oshiomhole vex, start to behave like say na him get di airport.

Air Peace staff suffer, passengers suffer, and Peter Obi come use di mata take preach about supporting local business.

Dis one na real airport drama wey get everything sarcasm, fight, politics, and even economic lesson.

Na Lagos airport be that, no dull moment at all!


Spread the love

Be the first to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published.


*