Popular Nollywood actress, Regina Daniels, don once again set social media market on fire with one cryptic post wey everybody dey talk about.
For her Instagram page, di beautiful wife of Ned Nwoko drop one photograph with dis bold line: “Even when di table turn, we go still dey chop for the table.”
This post na clear message to anybody wey dey doubt her or no believe say she fit survive any gbege inside her marital life.
Marital Wahala? Regina And Ned Nwoko Drama Dey Scatter Social Media
For di past few weeks, marriage gist between Regina Daniels and Ned Nwoko don dey trend body.
Pipo don dey talk say wahala dey for their marriage.
One viral video show Regina as she dey talk frustration because she no dey feel appreciated for her home.
But Ned no gree her go like Dat. E come publicly accuse Regina of abuse of substance and violent behavior.
Ned claim say she need to go rehabilitation, like say wahala don big for di actress.
Regina No Talk, But Her Post Fit Mean Say She Dey Shake Body
Till now, Regina never talk directly on top these allegations.
But her latest Instagram post wey calm and full of confidence show say she no dey worry at all.
E be like say she dey tell di world say she still stand gidigba, she still get control for her own matter.
Dis kind of calm vibe come hot because pipo don dey wonder if dis line na shade for Ned or if na inspiration for her fans.
Regina sabi make matter dey boil, and she still dey chop di diattention.
Private Jet, New House, Regina Still Dey Flex, No Dey Carry Anybody Suffer
She also show pictures of di new house wey she buy for Lagos, wey coem dey make pipo suspect say abi dis na fresh start or maybe one way to show Ned say she fit run her own matter anyhow.
Dis move just confirm say no matter how gbege full for her life now, she no go carry body dey suffer.
She dey live her best life irrespective of di marriage drama.
Wahala: Regina Daniels Marital Matter Na Everybody Talk Topic
Di tori dey controversial because nobody really know wetin di truth be.
But wetin dey clear be say, Regina Daniels and Ned Nwoko marriage matter don become public property.
Pipo dey choose sides. Some dey support Regina, some dey defend Ned.
Di drama don spark conversation about how women for showbiz dey suffer from private matters wey public dey put under microscope.
E also raise question about respect, privacy, and how social media fit destroy or build person for these kind of situations.

