Close Menu
wahalaupdate
    Facebook X (Twitter) Instagram
    Trending
    • Colgate’s Big Brother Naija Task Sparks Entertainment and Debate
    • Ukrainian Refugee Stabbing Exposes U.S. Safety Failures
    • Apple Unveils Thinnest iPhone 17, AI AirPods: Innovation or Hype
    • England Dominates Serbia World Cup 5-0: Shining Stars
    • UK Home Secretary Suspend Visa Over Migrant Wahala
    • Real Warri Pikin Gender Reveal Party Don Cause Big Wahala
    • Court Comot Ali Baba From Him Multi-Million Naira House
    • Péchier: French anaesthetist faces trial over alleged poisoning of 30 patients
    Facebook X (Twitter) Instagram
    wahalaupdatewahalaupdate
    Demo
    • Home
    • Latest News
    • Trending News
    • Hot Gist
    • Celebrity Gossip
    • Pigin Coner
    • African Tales
    • More
      • Contact us
      • About us
      • Write with us
      • Whistle Blower
      • Advert Placement
    wahalaupdate
    Home » Yahoo boys don bring national shame come Naija — EFCC boss
    Uncategorized

    Yahoo boys don bring national shame come Naija — EFCC boss

    wahalaupdateBy wahalaupdateJune 16, 20254 Comments0 Views
    Facebook Twitter Pinterest LinkedIn WhatsApp Reddit Tumblr Email
    Yahoo boys bring national shame come Naija — EFCC boss
    Share
    Facebook Twitter LinkedIn Pinterest Email
    Spread the love

    Omo, inside Monday, June 16, 2025, EFCC oga, Chairman Ola Olukoyede, vex talk all di grammar for Abuja

    Him no even send anybody papa he carry him wahala land for media briefing, dey shout say Yahoo boys don turn Naija to international laughing stock.

    If you never shame before, abeg, borrow shame now.

    From travel document to suspect file

    According to EFCC oga, if you carry your green passport waka go obodo oyibo, na automatic “suspect” Immigration officers go just dey look you like say you thief their mama wrapper.

    If dem no drag you go one corner, dem go use microscope check your bag. Na Yahoo boys cause am.

    Oga Olukoyede talk say, “If you see how dem dey look us for airport, you go pity your own face.

    Na so Naija passport don turn to “red flag” for international border.

    Hard work don die as yahoo don take over

    Di EFCC boss no gree rest. E say, “I come from state wey education be our pride, but now, if you reach secondary school by 12 noon, students don disappear.

    Dem don go dey hustle laptop.” Omo, na so hard work die, na Yahoo take over.

    If you see small pikin wey dey secondary school dey drive Benz, abeg, no ask question. Na “online business” e dey do.

    Oga EFCC no stop for there. E say, “No be only scam Yahoo boys dey do.

    If dem no see mugu to chop, dem go enter banditry, kidnapping, or even ritual”.

    E shock you? E shock me too! Some of these boys na money launderer for big politicians

    If dem steal government money, na Yahoo boys dem go use open crypto wallet, buy house for Dubai, or carry babe go Maldives. Naija na cruise.

    Abeg, make you no faint. Oga Olukoyede come yarn say dem catch one small boy, just 22 years, wey move over N5 billion in 18 months.

    Di boy never work before o! Na politicians dey use am wash their dirty money.

    If you see am for hotel, you go think say na Davido cousin.

    Na so Yahoo boys dey run things now. EFCC dey para, but Yahoo boys dey pop champagne.

    Yahoo don turn National career

    For dis Naija, Yahoo na new “civil service.

    “If you dey find job, na Yahoo be di answer. EFCC dey shout, but boys dey cash out.

    Oga Olukoyede say, “We dey arrest dem, but dem dey multiply pass mosquito for rainy season.

    If EFCC arrest ten, fifty go open new WhatsApp group. Na so di game dey strong”.

    EFCC boss para say, “You go see secondary school pikin dey drive car, dey lodge for hotel, dey do ritual.

    Na dem we want hand Nigeria over to?” E ask, but answer no dey.

    For dis Naija, if you no get Benz before 25, your village pipo go dey call family meeting.

    Oga Olukoyede brag say, “We don recover N365.4 billion, secure 4,111 convictions for 2024.

    But abeg, who Yahoo boys epp? As EFCC dey recover money, Yahoo boys dey buy new iPhone. Na so di rat race continues.

    EFCC dey try, but Yahoo boys dey win league.

    Oga EFCC tell him staff, “Abeg, make una dey professional, make una get integrity.

    “But for where? Yahoo boys dey use EFCC arrest as content for Snapchat.

    If dem catch one, dem go post am for TikTok. EFCC dey play catch-up, Yahoo boys dey run relay.

    For dis Naija, if you see Yahoo boy, abeg, respect am. E fit be your next landlord or senator.

    EFCC dey para, but Yahoo boys dey set national agenda. If you get green passport, just dey pray make dem no bounce you for airport. Na Yahoo boys dey write Naija story now.

    Omo, naija cruise no dey finish! EFCC dey shout, Yahoo boys dey cash out, and di rest of us dey watch like Netflix series.

    Who go win dis battle? Na only God and VPN sabi.


    Spread the love
    EFCC Immigration suspect Yahoo
    Share. Facebook Twitter Pinterest LinkedIn Tumblr Telegram Email
    wahalaupdate
    • Website

    Related Posts

    EFCC declares Sujimoto owner Ogundele wanted

    September 5, 2025

    Wife Found Dead During Intimate Moment with Another Man

    August 28, 2025

    EFCC denies political links in son-in-law case

    August 24, 2025

    4 Comments

    1. 🔧 + 1.597341 BTC.NEXT - https://yandex.com/poll/enter/3vh1vdEtSHMSNMif9mTCMS?hs=8f8eabbae90c12318095f735ecf1edce& 🔧 on June 18, 2025 3:39 pm

      vjt0yz

      Reply
    2. Pingback: EFCC and police clash over yahoo boy custody - wahalaupdate

    3. Pingback: Nigeria begins deporting convicted cybercriminal foreigners - wahalaupdate

    4. Pingback: EFCC declares Atiku’s son-in-law wanted - wahalaupdate

    Leave A Reply Cancel Reply

    Hottest Gist

    Colgate’s Big Brother Naija Task Sparks Entertainment and Debate

    September 10, 2025

    May Yul-Edochie Accused of Secret Cosmetic Surgery Loans

    September 8, 2025

    Temi & Mr Eazi’s Lavish Multi-Country Wedding

    September 7, 2025

    TikTok star Peller rise from nothing reveals generosity secret

    September 5, 2025

    TikToker Peller calls Davido stream failure; Wizkid transformative

    September 5, 2025

    Subscribe to Updates

    Get the latest creative news from FooBar about art, design and business.

    Colgate’s Big Brother Naija Task Sparks Entertainment and Debate

    September 10, 2025

    Ukrainian Refugee Stabbing Exposes U.S. Safety Failures

    September 10, 2025

    Apple Unveils Thinnest iPhone 17, AI AirPods: Innovation or Hype

    September 10, 2025

    England Dominates Serbia World Cup 5-0: Shining Stars

    September 10, 2025
    © 2025 ThemeSphere. Designed by ThemeSphere.

    Type above and press Enter to search. Press Esc to cancel.