Di Peoples Democratic Party (PDP) don enter serious wahala as dem suspend di screening of aspirants wey dem suppose do today for 2025 Elective National Convention because of “unforeseen circumstances.”
Dis suspension na just a few weeks to di big event wey party members dey hope for.
Di suspension cause plenty gbege inside di party as former Jigawa State governor, Alhaji Sule Lamido, vex wella say him no fit get di nomination form for National Chairman contest.
Lamido come talk say e go waka go court if dem block am from contesting.
Him even accuse say dem don dey control di nomination forms from Adamawa by Ahmadu Fintiri’s committee instead of di party headquarters.
Lamido talk say di way dem dey do am no follow party procedure and e dey “weird”.
Meanwhile, Tanimu Turaki, former Minister of Special Duties and one serious aspirant, submit him expression of Interest and nomination forms yesterday, wey dey show say di chairmanship race still dey.
Turaki don dey supported by majority stakeholders as consensus candidate but di situation don scatter as Lamido no gree.
plenty more wahala dey as over 20 PDP federal lawmakers dey threaten say dem go waka comot for di party.
Di reasonbe say? Dem dey accuse some party leaders say dem dey help woman nominee from former APC governor, Peter Mbah of Enugu State, to become PDP National Woman Leader.
Mbah recently comot from PDP go APC and dis kin move don dey cause kasala among loyal PDP women especially from South East states like Imo and Enugu.
Di aggrieved lawmakers want make di nominee comot or else dem go defect.
Ahmadu Fintiri, chairman of Di National Convention Organising Committee (NCOC), release statement say dem dey sorry for di inconvenience and promise say dem go fix new date soon for screening.
Di committee come still promise say di convention go hold on November 15–16, 2025, for Ibadan, Oyo State, and e go professional, transparent, and smooth .
Wahala For PDP: Na Only Drama Dey
PDP don turn to gbege house.
How pipo wey suppose dey organise party elections go block seasoned leader like Sule Lamido from buying nomination form?
Wetin dey happen. Some pipo dey try control everything behind door, spoil party name and scatter unity.
Lamido talk true say “if dem no let am contest, e go go court.”
But dis silence for party headquarters from party big men like Umaru Bature and Senator Samuel Anyanwu na clear sign say wahala dey .
Year 2025 dey near end and PDP suppose prepare well for 2027 election.
But dis kind internal crisis fit make APC dey smile.
No unity, no fight power. Lamido talk say PDP need “discipline, transparency and internal democracy” before dem fit face any battleground. E no get other way .
Who Fit Trust PDP Again?
Dis no be small matter. Over 20 lawmakers dey ready to run away because party no stand for dem loyal members.
Seyi Makinde dey conspired with party pipo to put dis aunty for national woman leader position, sidelining real loyal women from South East.
Una fit imagine PDP dey behave like dis, while dem dey claim to be alternative to APC?
Na real betrayal to party principles.
If PDP no clear diis crisis sharp sharp, e go affect trust and confidence before 2027 elections.
Dis tori na major gbege for PDP and Naija political landscape.
PDP dey face crisis wey go fit scatter am before serious election.
Make everybody watch dis space wella as things dey unfold for Ibadan convention.
Who go carry PDP leadership? Who go emerge victorious?
Make una join di discussion and share una own opinion.

