Bribbery-Police shoot tyre bicos of naira bribe

Bribbery-Police shoot tyre bicos of naira bribe

One big wahala wey happen for Onitsha Head Bridge inside Anambra State, for June 1, 2025.

Di mata dey cause serious argument and make pipo dey vex for naija, na so dem talk say police shoot driver tyre bicos say di man no gree drop bribe.

According to di pipo wey witness di mata for inside June 1, di pipo dem talk say wahala start wen police ask driver for bribe, but di man no gree pay.

As di driver stand gidigba, na so police carry gun burst di man tyre.

Dis kind wahala vex everybody wey dey there, as other drivers dem begin dey para.

Dis matter don open police yansh for di kind corruption wey full Naija police, and e dey make pipo dey ask if police dey do law enforcement or na just to dey use power anyhow.

Abi na law enforcement or na abuse of power

Plenty pipo wey see di mata for social media, talk say na checkpoint for Onitsha Head Bridge di thing for take happen.

Police ask truck driver for bribe, di driver com say “no”, police vex, shoot tyre, di motor no com fit move again.

Dis kind wahala com make other drivers and pipo wey dey pass begin dey shout.

Nobody understand why police go go dat far, so pipo com dey wonder weda na just one bad police or na di whole system get problem.

Some pipo dey support police say dem dey try maintain order, but many pipo dey vex say dis na pure extortion and wickedness.

Public vex and traffic wahala

No be only di driver suffer. Other drivers vex too, park their motors, as dem say dem no go move.

Na so everywhere com block for bridge, business and movement com scatter.

pipo gather, dey shout say make police buy new tyre before anybody move.

Di mata com turn to serious gbege between police and di pipo dem.

Dis kind boldness from di drivers dem show say pipo don tire for police wahala.

E show say Naija dey suffer for hand of di pipo wey suppose protect dem.

E also make pipo dey ask if police really get authority or dem just dey use am do dia own.

DPO show face: na real solution or just cover up

As wahala dey hot, na so DPO for di area com buy new tyre for di driver.

Pipo com dey happy as dem com even shouts, everywhere calm small, and traffic begin dey move.

But some pipo dey talk say di tyre wey DPO buy na just to make pipo calm down, e no solve di real problem of police corruption.

Some say na show, say e no go change anything.

Others com dey ask why police go reach dat level before DPO go com buy tyre.

Social Media Scatter: Everybody get opinion

As di story land online, everywhere scatter.

Hashtags against police brutality com dey trend, pipo com dey talk about how police dey use bribe and power anyhow for naija.

Some pipo dey defend police say dem dey try, but most pippo dey vex say police dey use uniform do anyhow.

One pesin for Twitter com talk say:

“wen police com turn to armed robber? Shooting tyre bicos pesin wey no gree pay bribe no be law enforcement be dat, na criminal wey dey wear uniform.

Another pesin com talk say:

“Dis na just small part of di wahala. Until police system change and dem begin punish bad eggs, dis kind thing go still continue dey happen.”

Di  real wahala: corruption full police

Dis Onitsha mata na just one out of di many mata.

Corruption, bribe, and abuse of power don make pipo no trust police again

Instead of to protect, many pipo dey fear police pass thief.

Dis case show say Naija need beta police reform  make dem train officers well, pay dem beta monie, and punish di ones wey dey misbehave.

If dem no do am, pipo go still dey fear and wahala go dey repeat.

Di way police shoot driver tyre bicos of bribe for Onitsha na serious mata e show say Naija police system get big wahala.

Even though DPO buy new tyre, e no mean say police dem don do wetin right.

Wahalaupdate dey beg police and government make dem take dis mata serious, an d dem investigate well, and do beta reform.

Naija deserve police wey go respect human rights, no be ones wey dey collect bribe and dey put fear for pipo body.

As pipo dey shout for change and accountability, make dis kind story follow push government make dem do beta.

Di big question be say: dem go hear word or dem go just forget dis mata like others?

Abeg, make una dey follow Wahalaupdate for more tori and updates like dis and other wahala wey dey naija.

Be the first to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published.


*