Retired Naija Army Major don die afta Kidnappers collect ₦10 Million Ransom

Spread the love

Dem no dey talk dis for play, wahala don land for Kogi State as retired Army Major, Joe Ajayi, wey be 76 years old and former CAN chairman for Kabba-Bunu, don kpai for kidnappers hand afta im family pay heavy ₦10 million ransom.

Dem say na for Odo-Ape, Kabba-Bunu LGA, Kogi State, na im di wahala take start.

Around 11:30pm for May 21, 2025, gunmen some wey carry beta weapon and dey shoot anyhow, burst enta Major Ajayi house.

Dem carry am go and no single police or soldier show face that night.

Na so dem disappear with am enta bush.

Di kidnappers first yan say na ₦50 million dem want if the family wan see Major Ajayi alive.

But as di family no fit raise dat kain money, dem begin dey beg.

Meanwhile, Major Ajayi health dey fall yakata because dem no gree make im medicine reach am unless di family pay extra money for di drugs.

Di family no get that one too.

As di man dey suffer for inside bush, di kidnappers come reduce di ransom to ₦10 million.

Dem yan di family say if dem no sharp, di man go kpai.

Out of fear and hope say di man still dey alive, di family rush arrange di ₦10 million, sell land, borrow, beg, do everything, pay di monie.

The real gbege:

Afta dem collect di ransom finish, na so di kidnappers direct di family say make dem go one place for bush go pick their papa.

When di family reach, na only lifeless body of Major Ajayi dem see.

Si man don die, cold body, no sign of life, no apology, nothing.

Na mortuary for Kabba Specialist Hospital dem carry di corpse go drop.

Community vex, government dey sleep:

Pipo for Kogi dey vex, say dis one na big slap for security.

How retired army officer, wey serve country, go die like chicken for kidnappers hand and nothing happen?

Dem say even first-class Oba, James Dada Ogunyanda, wey dem kidnap for Yagba West LGA since early May, never still come back.

Kidnapping don turn business for Kogi, people dey fear to waka for their own house.

Senator Sunday Karimi, wey dey represent Kogi West, don talk say the whole area dey under siege, pipo no dey sleep again.

But Governor Usman Ododo, during Sallah for Okene, just dey beg pipo make dem calm down, say dem dey try fight criminals.

But which fight, when pipo dey die anyhow and police no fit do anything?

Questions wey dey ground:

  • How retired soldier go dey inside own house, armed men go burst in, carry am, and nobody fit stop dem?
  • How kidnappers go dey negotiate for days, dey collect monie, and security pipo no fit trace dem?
  • Why dem go collect ransom, still kill di man? Abi na planned work?
  • Why government dey talk say dem dey work, but kidnapping dey increase every day for Kogi?

Pipo dey talk say na inside job, say some pipo for government or security dey chop with kidnappers.

How dem take know say di man sick, say im need medicine?

Why dem reduce ransom only when im wan die?

Why police no fit track di kidnappers, even afta dem collect monie?

Some dey say na politics, others dey say na pure wickedness.

Na so Naija don turn, where even retired army officer no dey safe, talk less of ordinary man.

Pipo dey ask, “If Major Ajayi fit die like dis, who then dey safe for this country?”

Di answer, na big question mark.

Major Joe Ajayi, retired army man and respected Christian leader, don die for kidnappers hand afta im family pay ₦10 million ransom.

Kogi State government and police dey o on owe ore talk story, but pipo no dey safe.

Kidnapping don turn business, and government dey look.

Di wahala never finish, and pipo dey fear who go be di next victim


Spread the love

Be the first to comment

Leave a Reply

Your email address will not be published.


*