Wedding turn burial Bauchi

Wedding turn burial Bauchi
Spread the love

Wedding turn burial Bauchi Sate inside June 14, 2025, na real gbege dey happen as one police officer, SP Mustapha Garba, wey suppose dey smile for wedding photo, use Benz do express ticket go meet him ancestor. Omo Naija wahala no dey eva finish

As e dey go him own wedding, na so accident carry am and two of him padi enter “Rest in Peace” mode before dem even reach reception, If na movie, dis one for win Oscar for “Best Plot Twist.” June 14.

When groom come turn to passenger go heaven

Dem say Mustapha and him three friends enter Mercedes Benz, dey cruise go Bargan Tsamiya, dey plan how dem go scatter wedding dance floor.

But as Naija road get him own plan, di Benz lose control, waka enter wrong lane, gbam.

Head-on collisions with Opel Vectra wey dey come from opposite direction.

Omo, na so wedding gown turn mourning cloth, and jollof rice turn to condolence food.

Police dey mourn, Bride dey wail, Villagers dey shock

CSP Mohammed Wakil, di Bauchi Police PRO, no fit hide him shock. E talk say, “di command dey mourn.

SP Mustapha Garba dey go him own wedding when di wahala happen.

”Na so police station turn sob center, bride dey cry, family dey ask, “Na who offend us?

“Even village pipo sef shock, dem never see wedding wey turn burial before di MC fit shout “ladies and gentlemen”

As news reach CP Auwal Sani-Omolori, di Commissioner of Police, e no waste time.

E order DPO of Toro Division make dem mobilize, rush go accident scene, evacuate victims go Toro General Hospital.

But before ambulance fit reach, Doctor don already talk say, “Sorry o, na only burial we fit do now.

“Groom and two friends don sign out for earth, na only one survivor remain dey fight for life”.

Enjoyments Benz don give dead

Na so Benz wey suppose carry groom go chop life, carry am go chop after-life.

Some pipo dey talk say, “If to say na keke napep dem use, maybe dem for reach wedding.

But Naija pipo sabi flex, Benz na status symbol, even if road no get joy.”

 Bride wey wait to say “I DO” don receive e don die message

Imagine bride wey don do make-up, dey wait for groom to arrive, only to hear say na mortuary dem carry am go.

Na so wedding planner begin pack cake, DJ off speaker, caterer dey share meat-pie for mourners.

Na real “from aisle to after life” mata.

Some pipo dey ask, “Bride go still wear wedding gown go burial?” Na Naija, anything fit happen.

You know say for every Naija tragedy, village pipo dey always get hand.

Some aunties for village don dey say, “We talk am say make dem no do big wedding, dem no hear.

“Baba Alajo dey blame bad road, Mama Nkechi dey blame over-speeding, but everybody dey collect meat-pie for condolence visit.

Na so Naija be, tragedy dey, but food must go round

From groom to ghost

As news break, social media pipo no waste time.

Twitter dey trend. “#GoneBeforeIDo,” Instagram dey post “From Groom to Ghost,” Facebook aunties’ dey write “It is well Na so Naija dey mourn and laugh at di same time.

Police don use di opportunity warn pipo say, “Abeg, if you dey go wedding, no over-speed.

If road bad, use okada, if you see Benz, pray before you enter

Dem talk say, “Life get as e be, no let enjoyment turn RIP.” But for Naija, who go hear word?

Next Saturday, another groom go still use Benz go wedding.

For dis country, if you dey plan wedding, make you plan burial join.

Naija road and Benz fit turn “happily ever after” to “Rest in Peace” before MC fit shout “make una rise for couple”.

”If you see groom for road, abeg, pray for am. If you see Benz, shine your eye.

Naija cruise no dey ever finish from wedding to burial, na small thing remain.

Omo, make we dey pray for beta road, beta life, and beta luck. Because for Naija, even wedding fit get plot twist wey Netflix no fit direct.


Spread the love

Leave a Reply

Your email address will not be published.


*