Wedding turn burial Bauchi Sate inside June 14, 2025, na real gbege dey happen as one police officer, SP Mustapha Garba, wey suppose dey smile for wedding photo, use Benz do express ticket go meet him ancestor. Omo Naija wahala no dey eva finish
As e dey go him own wedding, na so accident carry am and two of him padi enter โRest in Peaceโ mode before dem even reach reception, If na movie, dis one for win Oscar for โBest Plot Twist.โ June 14.
When groom come turn to passenger go heaven
Dem say Mustapha and him three friends enter Mercedes Benz, dey cruise go Bargan Tsamiya, dey plan how dem go scatter wedding dance floor.
But as Naija road get him own plan, di Benz lose control, waka enter wrong lane, gbam.
Head-on collisions with Opel Vectra wey dey come from opposite direction.
Omo, na so wedding gown turn mourning cloth, and jollof rice turn to condolence food.
Police dey mourn, Bride dey wail, Villagers dey shock
CSP Mohammed Wakil, di Bauchi Police PRO, no fit hide him shock. E talk say, โdi command dey mourn.
SP Mustapha Garba dey go him own wedding when di wahala happen.
โNa so police station turn sob center, bride dey cry, family dey ask, โNa who offend us?
โEven village pipo sef shock, dem never see wedding wey turn burial before di MC fit shout โladies and gentlemenโ
As news reach CP Auwal Sani-Omolori, di Commissioner of Police, e no waste time.
E order DPO of Toro Division make dem mobilize, rush go accident scene, evacuate victims go Toro General Hospital.
But before ambulance fit reach, Doctor don already talk say, โSorry o, na only burial we fit do now.
โGroom and two friends don sign out for earth, na only one survivor remain dey fight for lifeโ.
Enjoyments Benz don give dead
Na so Benz wey suppose carry groom go chop life, carry am go chop after-life.
Some pipo dey talk say, โIf to say na keke napep dem use, maybe dem for reach wedding.
But Naija pipo sabi flex, Benz na status symbol, even if road no get joy.โ
ย Bride wey wait to say โI DOโ don receive e don die message
Imagine bride wey don do make-up, dey wait for groom to arrive, only to hear say na mortuary dem carry am go.
Na so wedding planner begin pack cake, DJ off speaker, caterer dey share meat-pie for mourners.
Na real โfrom aisle to after lifeโ mata.
Some pipo dey ask, โBride go still wear wedding gown go burial?โ Na Naija, anything fit happen.
You know say for every Naija tragedy, village pipo dey always get hand.
Some aunties for village don dey say, โWe talk am say make dem no do big wedding, dem no hear.
โBaba Alajo dey blame bad road, Mama Nkechi dey blame over-speeding, but everybody dey collect meat-pie for condolence visit.
Na so Naija be, tragedy dey, but food must go round
From groom to ghost
As news break, social media pipo no waste time.
Twitter dey trend. โ#GoneBeforeIDo,โ Instagram dey post โFrom Groom to Ghost,โ Facebook auntiesโ dey write โIt is well Na so Naija dey mourn and laugh at di same time.
Police don use di opportunity warn pipo say, โAbeg, if you dey go wedding, no over-speed.
If road bad, use okada, if you see Benz, pray before you enter
Dem talk say, โLife get as e be, no let enjoyment turn RIP.โ But for Naija, who go hear word?
Next Saturday, another groom go still use Benz go wedding.
For dis country, if you dey plan wedding, make you plan burial join.
Naija road and Benz fit turn โhappily ever afterโ to โRest in Peaceโ before MC fit shout โmake una rise for coupleโ.
โIf you see groom for road, abeg, pray for am. If you see Benz, shine your eye.
Naija cruise no dey ever finish from wedding to burial, na small thing remain.
Omo, make we dey pray for beta road, beta life, and beta luck. Because for Naija, even wedding fit get plot twist wey Netflix no fit direct.


3 Comments
uonni5
Pingback: Temi & Mr Eaziโs Lavish Multi-Country Wedding - wahalaupdate
Pingback: Nigerian groom cancels wedding over โฆ1.5 million demand - wahalaupdate