On Friday morning, some boys refuse make EFCC carry dem comot go their station, them come pursue the EFCC operatives comot for di area inside Airport Road, Benin City, Nigeria.
According to reports, and video wey dem post for X, di video show as some boys gather dey pursue EFCC operatives for inside Airport road for Benin City.
Cult Boys Overpower EFCC Agents for Benin
Na so di EFCC operatives come vex comot go bring towing van wey dem go fit take tow di motor comot for di area.
Di fact for dis mata be say, for cult boys to overpower di EFCC agents don shows say those EFCC operatives pipo dem no dey real.
Dem go likely illegal pipo wey dey use those boys take dey ‘hustle’ rather than to dey do their official assignment.
EFCC Officers For Don Call Backup If Na Legal Operation
If to say this na di real mission, dem for don even dey shoot those boys sef.
If you dey live around this area, beta pack now because after God, na Government.
Di big problem here be say, EFCC operatives dey very toothless with di main yahoo boys.
Politicians dey thief monie everyday but dem no dey go after dem oo.
Poor Naija, Politicians Escape, Yahoo Boys Suffer
Plenty plenty comment dey flow socia media because of this mata
“@Dbanks345: tok say, Una nongo know di kind effects wey fraud dey cause until you go dey work for inside bank as an account officer or your papa or mama go work for bank as officer.
If you commit any crime with any bank account EFCC go come carry di PCM wey opened that account for you for questioning and something sef detention.”
@bigtompsfc: come tok say “Make everybody dey use their believe take dey protect their area make everybody mount him house.
No more destroying pipo houses and property all in di name of illegal arrest”
@stevealu: come tok hoim own say, abi EFCC operatives pipo dem go come dey claim now say no be their pipo carry out this operations?
Abi dem go come deny ownership of di Hiace bus wey dem come dey vandalized?
Public Don Lose Trust for EFCC Mata
Him tok say press release go fly any moment from now to take contradict di issue but di truth be say, di public don already lost trust and confidence for EFCC mata.
@sakura_eldian: At least di yahoo boys go dey put di evil mind wey devil don give dem for cultism take fight for something beta.
But if this mata continue, government go need to to address di issue.
We need to conquer this pipo before election if not nobody go fit come out go vote sef.
@blac_jezuz: come tok say everyday EFCC pipo dem dey go after young boys all in di name of fighting cyber crime meanwhile di real problem na di politicians wey dey basically give little or no hope for our kontri Naija dem go dey celebrate and worship dem.
As I don first tok before, make di youths of this our great kontri naija protect themselves at all costs

