Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don come issued urgent alert inside April 21, 2026, concerning crime impersonation scams and fake operations wey plety criminal dem ey commit.
This illegal groups dem don dey carry out plenty plenty fraudulent activities across major Naija cities.
Them dey pretend to be official agents so them go fit dey thief monie from innocent citizens and thief their valuable and personal assets.
According to di statement wey di Head of Media and Publicity wey be Mr. Dele Oyewale, this scammers dey use di agency’s name to take harass and collect monie from citizens wey no dey suspect them.
“Di wey them take dey operate be like say them dey lay ambush for some innocent youths wey dey come out of Eateries.
Them go dey go come dey harassed them with fake suspicions say them be internet fraudsters.”
Then them go collect all their valuables and property wey dey with them.
Key Tactics of Impersonators
Intelligence reports don identified plenty methods wey this fake official pipo dey currently used:
Them Go Carry Out Fake Detention Centers: some times, them go transport their victims go locations wey them don prepare for ground wey look like official EFCC offices to take finalize their extortion.
Motorist Extortion: Some gangs members go stop drivers for road under the guise say them wan carry number plate verification.
And them go use weapons to take make their victims compel, pay monie based on fabricated allegations.
Online “Raid” Content: Them go use content creators and online impersonators take stage dramatized “raids”. Them go scatter person doors enter person house.
Di EFCC don warns say this kind character dey bring bad image and public misconduct to di EFCC Commission’s reputation.


This protocol go require agents to present their valid identification during all their field enforcement activities.
This specialized procedures dey specifically designed to take protect Naija citizens from fraudulent impersonation.
So, di commission go fit uphold the integrity of di judicial process during some high-profile investigations across various sensitive financial sectors.
Di Commission emphasized say theis activities no dey reflect for their official protocols:
Standard Procedures: Legitimate EFCC operations dey follow strictly defined legal mandates.
No Night Raids: As of November 2023, di EFCC bin don officially banned night-time sting operations.
Official Channels: EFCC dey advised di general public to verify any enforcement activity.
And to report suspicious behavior or misconduct through official channels or for their nearest Zonal Command.
Official Source for Verification: Economic and Financial Crimes Commission (EFCC).

